Short Naija Joke: 14 Other Ways to Contact COVID-19 You Don’t Know

Estimated read time 5 min read
Short Naija Joke: 14 Other Ways to Contact COVID-19 You Don't Know

Short Naija Joke: 14 Other Ways to Contact COVID-19 You Don’t Know.

My people, i wan tell our people both for towns and villages about some easy and common ways we go take get and avoid corona virus.

Number 1.
Anytime you go bank, make sure say you carry ur biro or pen especially you wey dey borrow borrow biro and pen for bank. Because corona virus fit dey for that pen especially the pen and biro wey bank dey tie for their counter for customers. Imagine how many people don touch that biro with their virus hands. Addition to this matter na Bank ATM machine. Corona virus plenty for there. Make sure say you use hand gloves or cover ur hand with water proof before you use ATM or use hand sanitiser clean ur hand immediately you finish using the ATM.

READ: HOT 9ja Joke: The Dangers of Getting High While Driving

Number 2.
All the whole barber shop Plus hair salon na branch office for this wicked COVID 19 . No go barber or hair salon again. Barber ur hair for house or turn ur hair to Afro like James Brown.

Number 3.
My people especially you wey like to drink garri with groundnut make you think how people dey buy garri for market. People dey chuck hands inside the garri to taste abi you no sure say corona virus dey relax on top we garri? I think u understand.

READ: 10 Funny photos with captions to make you laugh all day ( 9ja Jokes Reloaded)

Number 4.
Some people, including us like to wack and chop fried groundnut wey dem dey sell for bottle. Hmm. This na groundnut wey somebody or people dey use their hands pill after dem fry thé groundnut. As them dey peel the groundnut na so dem dey talk or shout and saliva dey enter groundnut. The corona virus fit follow the groundnut enter bottle and somebody go buy immediately begin chop. Make we just think.

Number 5.
I think you remember bottle opener. When next you go where them dey sell drink, be careful plenty with bottle openers because virus fit dey for the opener since plenty people dey use the opener.

Number 6.
I think you know hôtel, that na the headquarters of COVID-19 oh because plenty people plus local and oyibo people dey sleep inside that room wey you want to enter. All that people don touch the TV and AC remote controls. Plus the wardrobe, door handle, hangers and light switches. Wicked virus fit dey somewhere inside that room.

READ: If You No Laugh For This Joke, You Need To Check Your Problems – Cool 9ja Jokes

Number 7.
If you want to really protect yourself and your family, make you and your family enter house, lock your gate and lock your front and back doors. And make you no let anybody visit una room or house because you no know where that person don waka enter before.

Number 8.
If you buy apple, carrot plus other fruits and vegetables, make sure say you soak everything inside water and wash with salt before you chop that apple or fruit.

Number 9.
Stop to dey touch another person telephone and property. Control your hand abeg.

Number 10.
If you must go out, make sure say you wear face mask. If you no get mask, use clean cloth or handkerchief. Abeg, wear your mask and no let person sidon or stand near you.

Number 11.
No use toothpick wey dem put for open plate for restaurant again. Many people don touch am since dem they select the one to use. U nor know who don get coro wey don already touch am.

Number 12.
If you enter okada, use face mask. No talk to the okada man when he carry you as he dey ride him bike because as he dey talk to you, breeze fit carry him spit put for your face and you no know whether him get coro or not.

Number 13.
Leave that woman alone or leave that man alone for now. Except na your husband or your wife. We be friends no dey here. Na from clap dem dey enter dance. Make everybody give each other small space because coro no dey show for face.

Number 14.
Make we obey all the things we government, Covid-19 PTF, media, elders and WHO say make we do, abeg.

Na health care people dey shower the whole of una with this message.
Make una too shower this message for all our villages and countri people to remove COVID- 19 from we country.

Una doh oh…

DO YOU HAVE ANYTHING YOU WANT TO TELL US ABOUT NIGERIA? CLICK HERE TO JOIN ESSENCE FORUM AND SHARE YOUR TOPICS WITH OVER 4000 MEMBERS.

WATCH MORE NEWS ON OUR YOUTUBE CHANNEL CLICK HERE TO SUBSCRIBE

Short Naija Joke: 14 Other Ways to Contact COVID-19 You Don’t Know.

From Toktok9ja Media

The views expressed in this article are the writer’s opinion, they do not reflect the views of the Publisher of TOKTOK9JA MEDIA. Please report any fake news, misinformation, or defamatory statements to toktok9ja@gmail.com

admin

Professional freelancer and webmaster.

You May Also Like

More From Author

+ There are no comments

Add yours